EGO!

Source: http://nigeriafilms.com

Ego,

Na becos of you I go school

Make I for learn

Make I know things

Make I take get work

So that my life go better

Ego,

Na because of you I go market

I come build house

I come buy motor

I come chop well

You sweet no be small

Ego,

Na because of you I dey popular

My friends dem borku

My enemies yanfuyanfu

My elders sef respect me

Babes no dey finish

Ego,

Na you bring my palaver

No sleep again

No rest of mind

No where to hi de

E don get as e be

Ego,

Na many names you get

Oyibo call it money

Hausa call him kudi

Yoruba call her owo

As I see am so poverty no be curse.

By Chovwe Ogbe for http://nollywoodgists.com